GOD ABEG

J

 

 

Baba God I don come again

Cos if I no come wetin I gain

Yes I no say I be your pikin

But blood don dey rush from my ink

 

Day no go break finish

We don leave house making a wish

To come home at least with a fish

Yet we no dey see

 

We go work work tire

Come back con meet empty pot

At night we soak garri

Abeg I don dey worry

Na small pikin i be 

I no wan craze catch me

 

My fellow children don dey hide their biscuits from me

Say I be longer throat

Dem no no na hunger dey do me

I no fit tell them cos dey go laugh me

 

Na why i come to you today

With tears in my eyes I pray

Make you come to our aid in a haste

Before dem turn us to a waste

 

I get things wey I wan become

Trailer load of dreams I wan fulfill

How I wan take do am when I never chop bellefull?

 

Na why I come to you 

Remember you talk say anybody we get trust in you

You no fit put that person to shame

Rather e go become fame

 

Baba abeg run am for me

Cos I no fit make am without you

As fish no fit survive without water

Na so I no fit survive without you.

Comments